Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK
Ghana don drop points for dia 2026 World cup qualifier for N’Djamena.
Di Black Stars bin dey lead di game 1-0 from di 17th minute wen captain Jordan Ayew score di goal from one cross by Mohammed Kudus.
Afta di goal, Ghana get plenty chances to score di second goal but Caleb Yirenkyi and Antoine Semenyo bin blast dia shots ova di bar.
Na so dem drop di tempo for di second half bifor Kamaldeen Sulemana of Atalanta don enta di game wey im carry some goal-threat.
Im try some shots from outside di box but none of dem fit trouble di Chad keeper Mbayenaissem Jourdain.
Wit few minutes to end di game, Chad see say dem fit to grab goal if dem pepper di black Stars defence.
Na so dem try wey dem get dia equalizer for di 89th minute. Ecua Celestin carry di ball wey he dance around three Ghana players bifor im shoot di ball; di ball now deflect off a Ghana defender wey e enta di net.
Dat na di only chance di Les Sao bin get for di whole game, wia dem carry score dia goal to lift di fans for dia new stadium.
Ghana still dey lead di group wit 16 points afta dis draw.
Comoros and Mali go play each oda later on Thursday night.
If Comoros win, dem go get 15 points, na so if Mali win, dem go get 12 points.
Madagascar wey currently dey second wit 12 points go fit get 15 points if dem fit beat Central Africa republic.
If CAR beat Madagascar, dem go remain fifth for di table wit 8 points.
Blackstars coach go vex say di team don drop points for match wey dem suppose win, but dem go hope to do di work vs Mali when dem enta Ghana on Monday 8 September.
Second Half
Wia dis foto come from, GFA
Referee don blow whistle to end di game. Chad celebrate dia first point for di qualifiers for dia new stadium.
93″ Chad keeper sit for ground afta one ball into di area.
Ghana bin dey change anoda player, Elisha Owusu comot for Jerry Afriyie for extra time.
Which of di teams fit score again to win dis game?
90″ Dat goal don raise di noise for di stadium as di game dey come end.
88″ GOOOOOAAAAL! Ecuacelestin don shoot di ball wey e don deflect off one Ghana player wey e enta di net. 1-1
Kamaldeen Suleman don strike di shot off target afta di short corner. Goalkick for Chad.
87″ Corner for Ghana for di far right. Ghana no dey in hurry to take dis corner.
86″ Coach don comot Mohammed kudus wey im carry Osman enta di game.
Sulemana create chance wey im pass to Jordan, instead say im go shoot di ball, di captain bin delay di ball wey Chad bin clear.
84″ Ghana get counter attack wit Jordan and Sulemana but di two players don slow di pace wey dem now dey pass di ball around.
82″ Goalkeeper catch di ball wey im carry enta for counter. Gideon Mensah don do mistake for di back wey almost cause Chad to score, but Tchaouna im shot dey weak.
81″ Corner for Ghana. Kudus lift one ball ova di top for Bonsu, but Chad defend for corner.
80″ Chad wan create sometin to lift di fans for here; di player dribble two Ghana players but im final ball dey weak.
79″ Kamaldeen bin dey complain say im marker don stamp im leg but referee no gree. Chad bin change two more players for di rest of di game now.
78″ Kamaldeen Sulemana don hit shot on target afta im dribble two players. Di keeper don catch di ball.
Ghana coach carry fresh legs to try and create sometin for dis game.
76″ Ghana bin dey change two players – Kamaldeen Suleman and Christopher Bonsu-Baah don enta di game, Semenyo and Inaki Williams don comot.
75″ Chad now dey try put pressure for di Ghana defence as time dey go on but dia final balls no good eniugh.
Di tempo of dis game don drop for di last few minutes. Di blackstars wan reserve dia energy for di game against Mali on Monday.
72″ Ghana bin lose di ball for midfield – Chad begin counter attack but di Ghana defence clear di danger.
70″ Kudus don foul Dia Wah Mickael afta im try to win di ball from di defender inside di Chad area; na so di crowd bin roooaaaarrrr!
Ghana coach don dey wait to make changes.
68″ Elisha Owusu don fall for ground afta Chad player don stamp im leg afta im pass di ball.
67″ CHAAANCE! Kudus try to bend di ball for di far corner afta Caleb Yirenkyi don cut di ball back inside di Chad box. Di ball go ova di bar.
65″ Dia Wah Mickael, di left back for Chad don hurt im serf as im dey throw di ball for di halfway line; in sit for ground for treatment.
64″ Amine Hiver wey be striker don enta di game to replace Haroun Tchaouna wey still no recover from di injury.
63″ Chad try to create counter attack, na so di ova 20,000 fans for di stadium begin to dey shout; but Gideon Mensah don clear di danger.
62″ Ghana bin try to create anoda goal chance but di Chad defender block Kudus from making a pass.
60″ Haroun Tchaouna don hurt; im comot di game wey im vex about di injury. But afta treatment im don enta di park again.
Wia dis foto come from, GFA/FTFA
59″ CHAANCE! Yves Allarambaye don strike di ball into row Z afta di ball don fall for im side. Ogbonge chance be dat wey di player don miss.
58″ Dem don change Abdoul Aziz wey Frank Tchaouna don enta di game.
56″ Tchaouna Haroun tink say im get penalty afta im dance for di box wey im fall for ground under pressure from Adjetey; but referee blow for play on. Tchaouna bin dey for ground for treatment.
54″ CHANCE! For di oda end, Chad bin create counter attack wia di ball bin fall to dia number 11 player Ecuacelestin shoot di ball ova di bar.
53″CHANCE! Tchauplaou Charle don block Mohammed Kudus from shooting inside di box.
51″ Inaki Williams bin pass di ball inside di channel for Semenyo but Chad defenders use body shoulder di Bournemouth player.
Kudus don lose di ball for di Chad box as im try to dribble two, three players. Bifor dat, Inaki and Jordan bin hold di ball well to create space for dia teammates.
OFFSIDE! Defender Jerome Opoku don play one ball ova di top for Jordan but im enta di offside trap.
49″ Di ball don return to midfield; wit plenty passes between di players.
48″ One long ball from di back to Inaki Williams, di Bilbao player bin trap di ball but im backflip no find im teammates.
47″ Throw-in to Ghana. Gideon Mensah bin throw am sharp sharp.
46″ Ghana don collect di ball now wey dem also begin to pass am around until dem play one ball to Gideon Mensah for di far side.
45″ Chad bin pass di ball wey dem begin to pass among diaserf for back bifor di ball comot for throw.
First Half
Wia dis foto come from, FTFA
Referee don blow whistle for halftime. Ghana 1-0 Chad.
45+2″ Abdoul Aziz don win freekick. Dem take di ball straight into di hand of di Ghana keeper Asare.
Gideon Mensah don cross ball for di box, Inaki Williams don stretch but im no reach dat ball.
44″ CHAAAANCE! Jordan Ayew bin play one sweet pass thru di Chad defence for Semenyo but di Bournemouth striker carry anger balloon di ball ova di bar when e dey easier to score
43″ Nice interplay between Jordan, Semenyo and Elisha but dem carry di ball go back.
Di blackstars wan manage di time wey dem bin dey pass di ball among diaserf until chance don open for kudus for di far side.
41″ Elisha Owusu don win freekick near di centre of di park.
Di fire for dis game don quench as we dey approach halftime.
40″ Throw ball for Ghana afta Chad cpatain Mbangossoum Eric don hustle di ball from Gideon Mensah.
38″ Elisha Owusu try im best to win throw-in for di far left side of di Chad area. Di blackstars carry di ball go back.
Kudus boot di freekick from far away into di box; Opoku try to hit di ball back into di 6-year box, na so Chad don head di ball for corner.
36″ Semenyo don win freekick afta three Chad players bin hack am for ground. Captain Jordan Ayew no happy wit di way dem foul im player.
From di freekick, Chad don carry di ball go ova di bar from one tight angle. Di chance don vanish.
34″ Freekick fior Chad. Haron Tchaouna bon dey cause all sorts of problems for Ghana as Caleb Yirenkyi now hold im shirt.
33″ Kudus don get anoda ball for di wings wey im dance around bifor he bin lift one cross for di box, but Chad keeper don catch dat ball wit no stress.
30″ Freekick to Chad afta Opoku don use style drag di player for ground
28″ Kudus don win freekick deep for di Ghana area.
27″ Game don resume afta di cooling break. Jerome Opoku don enta dipark afta treatment.
25″ Jerome Opoku bin dey for ground afta Abdoul Aziz don foul am inside di Ghana area. Opoku dey receive treatment wey di players use di chance to drink water.
23″ Chad take di short freekick but di final ball dey poor, Ghana now try to counter attack but Semenyo dey offside.
22″ Haron Tchaouna bin dey worry di Ghana players, im carry di ball pass three players bifor Elisha Owusu don foul am for di first yellow card for di game.
21″ Gideon Mensah don lose di ball for im area – but Elisah Owusu don recover well to collect di ball back for Ghana.
20″ CHANCE! Ghana bin dey create anoda chance wit Semenyo for di left hand side of di Chad box; im cross di ball inside di area wey di ball fall to defender Caleb Yirenki, di player don ballon im shot ova di bar.
19″ Tchaouna Haron don win freekick as im try to dribble Caleb Yirenkyi.
Inaki Willaims and Elisha Owusu bin create dat ball for midfield bifor dem pass to Kudus for di cross into di area.
16″ GOOOOOOAAALLL! Captain Jordan Ayew tap di ball inside di 6-yard box to score from assist by Mohammed Kudus.
15″ Jordan Ayew tink say im gatz freekick but referee blow play on na so dem continue to dey play.
14″ Chad wan enta di Ghana area but defender Caleb Yirenkyi don use im body protect di ball wey e go goalkick.
Jordan don take di corner bifor di Chad keeper Jourdain carry punch clear di ball.
13″ Corner to Ghana afta Yves Allarambaye block Antoine Semenyo wey bin dey enta di box.
12″ Koularambaye Damba don win freekick inside di Chad area afta Kudus don hack am for ground.
11″ Chance! Chad bin create some chance for di Ghana area bifor Abdoul Aziz don ballon di ball into di stands.
10″ Ghana take di corner – as dem bin dey struggle for di ball inside di box, Chad keeper Jourdain don comot to punch di ball wey im hit Jerome Opoku im head.
9″ From dat passage of play, Kudus don win throw ball against di Chad defender.
8″ Freekick to Ghana afta dem binfoul Jordan Ayew. Dem hit di freekick but di ball don spoil.
Ghana bin win di reverse fixture for Accra 5-0. Chad dey bottom of di group wit zero points from six games wit only one goal.
5″ Both teams dey try to dominate possession wia Semenyo fail to connect di ball to captain Jordan Ayew wey bin dey for good position. Chance don vanish.
Chad bin dey try to enta di game wit some good passes and chances but dia final ball no be good enough
Les Sao don carry di ball go back to dia goalkeeper.
3″ Chad don get frekick 30 yards from di Ghana box but di kick don hit di wall.
2″ Ghana begin to create early chance between Jerome Opoku, Jordan and Semeyo, but di final chance no give di keeper any trouble
1″ Referee don blow whistle for game to start. Ghana go take ogbonge step towards di world cup iof dem win.
Di weather don set for dis game for di new stadium, di first time di team dey play bifor dia fans in six years.
Both teams don comot for park. Ghana bin dey wear dia white jersey wey Chad don dey wear dia traditional blue jersey
Welcome everibodi to dis live commentary game between Chad and Ghana.
Wia dis foto come from, GFA
Villarreal midfielder Thomas Partey dey bench as Black Stars coach select Inaki Williams, Antoine Semenyo and Jordan Ayew to lead di line for dia 2026 World Cup qualifier wit Chad.
Di former Arsenal midfielder bin dey face rape charges for England; wia di court adjourn dia last hearing bifor Partey don join di Blackstars squad.
Ahead of di game, Otto Addo wey bin complain about di quality of di artificial pitch for N’Djamena say di Blackstars gat to focus on di three points to push dem closer to qualify for di tournament.
Les Sao coach Raoul Savoy bin also name strong starting lineup for di game wey im tok say dem go play wit pride for dia new stadium.
Chad bin dey without a point from dia six games, wey dem dey bottom of Group I.
Im go dey count on home advantage to secure good result against di Blackstars.
Ghana XI: Benjamin Asare (GK); Caleb Yirenkyi, Jonas Adjetey, Jerome Opoku, Gideon Mensah, Elisha Owusu, Abdul Samed Salis, Mohammed Kudus, Inaki Williams, Antoine Semenyo, Jordan Ayew.
Chad XI: Mbayenaissem Jourdain, Ecuacelestin, Tchauplaou Charles, Abdoul Aziz, Wanre Daikreo, Dia Wah Mickael, Tchaouna Haroun, Koularambaye Damba, Yves Allarambaye, Thiam Mahamat, Mbangossoum Eric.