Ghana vs Central Africa Republic highlights: Black Stars beat CAR 5-0 to move closer to 2026 World Cup

0
6
Ghana vs Central Africa Republic highlights: Black Stars beat CAR 5-0 to move closer to 2026 World Cup


Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Ghana dominate CAR as dem sweep dem aside 5-0 to almost secure qualification for di World Cup

Ghana wallop Central African Republic 5-0 to put one leg ahead for di 2026 World Cup.

Di Black Stars put in five-star performance for di game wey dem play for Morocco.

Goals from two defenders – Mohammed Salisu and Alexander Djiku as well as Captain Jordan Ayew, Thomas Partey and substitute Kamaldeen Sulemana seal di three points afta di dominant display.

Wit dis result – Ghana get 22 points at di top of Group I, Madagascar wey win dema game 2-1 vs Comoros dey second wit 19 points.

Mali beat Chad 2-0 to dey on di same points (15) wit Comoros.

Ghana go face Comoros for di final group game for Accra, wey Madagascar go take on Mali.

Three teams dey fight to finish second for dis group.

As tins stand now, Ghana need at least one point to confam dema place for di world cup.

Di fans go hope say di Black Stars go repeat di performance against CAR for dat game at di Accra sports stadium on Sunday.

Dis be di second time Ghana record 5-0 during di world cup qualifiers afta dem score Chad by di same margin for Accra.

Ghana players dey celebrate

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Ghana need only one point from dema last game v Comoros to qualify

Highlights

Referee blow whistle for di end of di game. Ghana scatter CAR 5-0 for dis qualifier.

90+2″ Sulemana dey offside as he try to meet one long ball

Madagascar still dey second wit 19 points, if dem manage to hold on and win, dem go remain at 19, three points behind Ghana.

Madagascar dey lead Comoros 2-1 as tins stand now wey Mali dey lead Chad 2-0.

Dem add three minutes to di game.

Ghana dominate dis game from start to finish, 5-star performance from di Black Stars.

86″ GOOOOOOOAL! From one sub to anoda. Painstil dribble CAR players for di far right bifor e cross di ball to Kamaldeen Sulemana to score im first Ghana goal. 5-0

85″ CAR take one rare corner but dem no fit trouble di Ghana backline. Di score remain 4-0

83″ Elisha Owusu win freekick for di centre of di park.

Time dey run out for CAR to even try to get a consolation goal.

OFFSIDE! Kudus dey offside afta Jordan play one ball for am. Dat be im final contribution for dis game as Prince Owusu and Jerome Opoku replace di Spurs winger and Mohammed Salisu.

Ref whistle for foul against CAR as dem foul Joseph Painstil.

80″ Chaaance! Jordan Ayew try to score from di edge of di box wit a curler but di ball go wide.

79″ Ghana get anoda corner but dis time, dem no fit capitalize.

76″ Elisha Owusu already commit foul as e enta di game. Wit di fresh legs di coach introduce, dem go manage di game

Ghana coach now make changes – e comot Semenyo, Partey and Fatawu wey e carry Joseph Paintsil, Elisha Owusu and Kamaldeen Sulemana enta di game.

75″ Kudus try to meet one long ball ova di top but di CAR keeper save di ball.

70″ Jordan Ayew now get one goal and two assists for dis game. Ghana coach go try and make some changes to rest some of di players ahead of di final game on Sunday.

GOOOOALL! Ghana score again. Dis time captain Jordan Ayew score from one diagonal cross 4-0

68″ CAR now dey beaten black and blue. Dem no go fit comeback from dis score.

GOOOOOAL! Anoda defender, anoda header. Alex Djiku rise to meet Jordan Ayew corner for di goal. 3-0

67″ Ghana win anoda corner. Jordan Ayew go take am

65″ CAR dey try to get into di game in di last 10 mins wit pace and long balls behind di defence.

Scenes! Ghana captain Jordan Ayew vex for im CAR opponent afta dem fall for ground. Dis spark fight as di ref intervene wey e show Jordan Ayew yellow card.

63″ Semenyo dey prepare to take anoda long throw for di CAR area afta Jordan win di ball.

61″ CAR dey find spaces for di Ghana defence now as dem dey misplace passes for di last 5 mins, Salisu defend well but e make lucky to avoid a yellow card from di ref.

59″ Kudus, Semenyo and Fatawu combine to create anoda chance for Ghana bifor CAR defend Kudus’s cross into di box.

CAR still no get any clear shot on target so far for dis game.

58″ Baboula from CAR shoot one ball towards di Ghana area, di ball no threaten di keeper sef.

Kwasi Sibo carry di ball dash di opponent, immediately e raise hand to apologize.

57″ Captain Jordan Ayew no happy about di CAR player wey foul am for di centre area.

Anoda CAR attack put Ghana defence under pressure, Gideon Mensah clear di ball for throw-in to CAR.

54″ CAR try to create a chance for themselves but Ghana clear di danger.

53″ Di Villarreal midfielder take dat goal well afta Jordan pass di ball to am, e beat im marker, wey e dummy di keeper bifor e shoot into di net.

GOOOAAALL! Thomas Partey score di second goal afta good hold-up play by captain Jordan Ayew. 2-0

50″ CHAANCE! Alex Djiku again for di far post miss anoda sitter. Semenyo put one long throw into di CAR box, di ball fall to di Spartak Moscow defender for di second time at di back post, but he stab di ball wide

Afta dat corner, di ref call Semenyo and di CAR keeper wey e tok to dem to calm down.

Chance! Kwasi Sibo head di ball from Kudus’ corner ova di bar.

Ghana win anoda corner as Yirenkyi try to cross di ball for di far side.

46″ Groethe try to connect wit im teammate for dia own area but Ghana collect di ball.

Second half start, wit CAR trying to create some early pressure.

45″ Di players comot for di park for di second half.

CAR remain fifth wit 5 points and Chad be bottom of di group wit 1 point.

Mali and Comoros get 15 points but Mali be third wit dia 1-0 scoreline v Chad.

As tins stand now, Ghana get 22 points, Madagascar get 19 as dem dey lead Comoros 1-0 for halftime.

semenyo

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Two defenders score during di 5-0 thrashing

First Half

Ref blow whistle for halftime.

Semenyo try to shoot one final ball – but goalkeeper Goalkeeper Youfeigane catch dat ball easy.

+1 Dem add only one minute to dis first half.

45″ Grothe try to create sometin for CAR inside di Ghana area but di Ghana midfielders make alert to clear di danger.

44″ Semenyo beat di CAR backline for di first time today wey e cross di ball inside di box, but CAR clear.

Oh! Ghana keeper Benjamin Asare dribble CAR defender inside di six-yard box. Tricky tin e do for there, but e make lucky say di skill click wey e manage to kick di ball inside.

42″ As halftime dey approach, CAR dey try at least to get one shot on target.

CHAAANCE! Semenyo use im chest to hit a fine Jordan Ayew cross wey di ball comot for goalkick. Great play by Jordan

40″ CAR still dey struggle to hold di ball even afta Ghana lose possession.

39″ Fatawu Issahaku try to find Semenyo inside di box wit one cross ova di top but Goalkeeper Youfeigane comot wey e catch di ball.

37″Chaaance! Ghana miss one biiiiiiig chance in front of goal, afta Semenyo head one ball down for di Spartak Moscow defender afta di freekick, but e balloon di ball ova. Dat easily fit be di second goal.

34″ Fatawu Issahaku try to shoot from di halfway line as e spot di keeper out of im line. Di ball go inches wide.

35″ Ghana get free kick in front of di CAR area afta dem foul captain Jordan Ayew, but di ball spoil.

Kudus. dey get so much joy for di far right side, dis time, e cross di ball wit im right foot into di box. But Partey side foot di ball to hit a CAR player. Di chance vanish.

Chaaance! Fatawu Issahaku use im left foot try to place di ball into di far corner but di ball dey too high.

32″ Ghana dey try possess di ball now, between Kudus and Jordan, dem hold di ball wit some fine skill for di left side of di CAR area.

30″ Di game restart. CAR now try to apply pressure for di Ghana players.

Ref stop di game as one Ghana player, Fatawu dey for ground.

28″ Fatawu Issahaku waste one fine counter attack for Ghana wit im skills; di ball now dey wit CAR.

27″ Throw ball for CAR afta Ghana fail to clear di ball away inside dia penalty area.

25″ Ghana keeper Asare rush out to collect one ball as CAR try to attack for di far side.

23″ Kudus, Fatawu dey worry di left hand side of CAR wit dema pace and crosses.

Sibo, di Real Oviedo midfielder head di ball against di defender bifor e carry leg hit di follow up ova di bar.

Chaaaance! Kwasi Sibo get chance to score from anoda corner dis time from Jordan Ayew.

Goalkeeper Youfeigane no fit collect dat ball. Ghana get more dan five corners.

GOOOOOOOOOOAAAAL! Mohammed Salisu head one Kudus corner into di net.

Fatawu do well for anoda attack wey e cross into di box for anoda corner.

18″ Mohammed Kudus dribble two, three players wey e play one fine ball ova di top. But CAR defend dia line

17″ CAR dey try to possess di ball for a few seconds to reduce di pressure on dia team.

From di corner Salisu head di ball wide. Chance vanish.

15″ Leicester City winger Abdul Fatawu use im pace to win anoda corner from Basse.

Jordan Ayew try to hold on to di ball in di CAR area bifor dem foul am.

14″ Tins go begin to heat up if di Black Stars hear about di result for di oda game.

Madagascar score for di oda game to lead Comoros 1-0. Dis score now dey take Madagascar to 19 points as Ghana now get 20 points wit dis draw.

10″ So far, dem dey play di game for di halfway line; CAR dey rely on quick counter attack to hurt di Black Stars.

Goalkeeper Youfeigane save one shot from Kudus as Ghana dey try to create chance for dis first half

7″ Ghana get two corners in quick succession as di pressure begin to pepper di CAR defence. But Kudus corner beat everibodi for goalkick.

Gideon Mensah from Ghana cut out anoda counter attack from CAR

5″ Early pressure on di home side CAR so far but dem clear dia lines, especially thru dema defender Basse

3″ From di corner, CAR launch fast counter attack but Ghana manage to defend to clear di ball.

2″ Chaance. But CAR defend wey di ball comot for corner.

Slow start for dis game now; nobody wan make early mistake. But di two coaches already make active for di touchline.

Captain Jordan Ayew dey ginger im players to put pressure afta dem pass di ball for centre line.

1″ Ref blow whistle for game to start.

Referee dey check if everitin make set for dis game to begin. Remember, Comoros and Madagascar also dey dia game at di same time.

At dis time di national anthems of both teams dey ring for stadium.

Ghana dey wear dema all-yellow jersey wey CAR dey wear dema blue jersey.

Both teams comot for di park now

Welcome everybodi to dis 2026 world cup qualifier between Ghana and Central African Republic.

Ghana and CAR IX

collage of Antoine Semenyo and Louis Mafouta

Wia dis foto come from, JARED TILTON VIA GETTY/PATRICK SMITH/GETTY

Wetin we call dis foto, Ghana fit take one step close to di 2026 World Cup if dem win dia game against Central African Republic; dem go seal qualification if dem win and Madagascar and Comoros drop points

Asare (GK); Djiku, Salisu, Mensah, Yirenyi, Sibo, Partey, Kudus, Jordan, Fatawu, Semenyo

Coach Eloge Enza name dia starting line up for dis game.

Youfeigane (GK), Yangao, Gambor, Basse, Fourdeau,Namsona, Oualengbe, Pirioua, Grothe, Namnganda, Baboula

CAR team

Wia dis foto come from, FEDERATION CENTRAFRICAINE DE FOOTBALL

Wetin we call dis foto, CAR get only 5 points from 8 games during di qualifiers; dem fal to qualify for di World Cup but dem go try to upset di Blackstars
scenes from the Ghana v CAR game

Wia dis foto come from, GHANA FOOTBALL ASSOCIATION

Wetin we call dis foto, Ghana beat CAR 4-3 for di first leg of dis fixture for Baba Yara Stadium in Kumasi



Source link

Leave a reply

Please enter your comment!
Please enter your name here